Blog

Change di Way You Dey Think

Abeg share am


Message: Many times, di biggest battle no dey outside us, na inside awa mind. Before life fit change, di way you dey think must change first. Your mindset be like lens wey you dey use take see life—if e dirty or dey cracked, everitin go look wrong.
Bible tell us sey, “As a man think for hin heart, na so he be.” If you kontinu to dey tell yourself sey you no fit, life go agree wit you. But wen you align your mind wit Baba-God’s truth, strength go rise where weakness bin dey before. God no create you to manage life; He create you to overcome.


Changing your mindset no go happun overnight. E go first start wit wetin you dey allow enta your mind—your thoughts, your words, plus di voices wey you dey listen to. Replace fear wit faith. Replace doubt wit Baba-God promises. As your mindset change, your actions go change sef, and your results go follow.

Bible Verse:
“No dey follow di pattern of dis world, but ugrade yoursef by changing your thinking, so dat you go fit confam wetin dey good, and wetin Baba-God go accept, plus Baba-God perfect wish.” — Romans 12:2 9 (Pidgin Bible)


Prayer:
Oh Baba-God, upgrade my mind everiday. Epp me to see myself plus my situation di way You dey see dem. Make my thinking align wit Your truth. Amen.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Social Media Auto Publish Powered By : XYZScripts.com