Trust Baba-God Even Wen e No Make Sense
Message:
Today, Baba-God dey tell you make you trust am, even wen wetin dey happun around you no clear. Faith no be to trust Baba-God only wen everitin dey sweet; faith na to trust am wen road ruff and you no see light yet.
Sometimes Baba-God go lead you go road wey you no understand. E fit pain. E fit confuse you. But remember sey Baba-God no dey make mistake. Wetin you dey see now na process, no be punishment. Baba-God dey build sometin wey big pass wetin your eye fit see.
Wen you no understand Baba-God plan, no fight am. Chill. Rest. Trust. Baba-God fit use delay to save you from katakata. Baba-God fit close one door to protect your future. Wetin you dey call setback fit just be setup for breaktru.
No measure Baba-God by your feeling. Measure am by Hin character. Baba-God good yesterday, today, and forever. If He don epp you before, He go eep you again. Your story no go end for confusion.
Tell yourself today: “Even if I no understand am, I still trust Baba-God.”
Bible Verses:
“Trust Baba-God wit all your heart, no depend on your own understanding.
— Proverbs 3:5–6 (Pidgin Bible)
“Wetin Baba-God dey do now, you no fit understand am now, but you go lata understand.”
— John 13:7 (Pidgin)
Prayer:
Baba-God, even wen I confused, I choose to trust You. Epp me make I no trust on my own sense. Lead me di way wey You know best. Amen.
Positive Confession:
Today, I trust Baba-God fully. My steps dey ordered, even if I no see am clearly. Baba-God dey guide my life, and everitin go work for my good. Amen.


