Think Big
Message: Many times we dey limit awasef becos of fear, background, or wetin pipo dey tok. But Baba-God no dey think small. From di beginning, Hin plan big tins for Hin pikin dem. Wen Baba-God put dream for your heart, no make am small because e look too big for you. Remember sey na Baba-God give you di vision, and na still Am go supply di strength.
David be small boy wen he face Goliath, but hin faith big pass di giant own. Joseph dream big even wen life push am inside pit and prison.
God use those big dreams to change nations. If God fit do am for dem, He fit do am for you sef.
Thinking big no mean pride; e mean trusting Baba-God fully. Stretch your faith. See beyond your present condition. Pray big prayers, take wise steps, con leave di result for Baba-God. As you think big wit Baba-God, He go surprise you wit results wey pass your imagination.
Bible Verse:
“Now unto am wey fit to do pass everitin wey we ask or think…” — Ephesians 3:20 (Pidgin Bible)
“Add more space join your compound, and make dem stretch di curtain of where you dey stay. No hold back. Make una gada more building materials…”. — Isaiah 54:2 (Pidgin Bible)
Prayer:
Lord, help me to remove fear and limitation from my mind. Teach me to think big and trust You for great things. Amen.
Positive Confession; Oh Baba-God, open my mind to fit carry big ideas plus big dreams. From today na only big-big tins I go dey reason. Amen.


