• Blog

    Wisdom To Manage Moni Well

    Message:Today, make you remember sey money wey you manage well go last, but money wey you spend anyhow go run like water. Pidgin proverb tok sey, “Water wey dem no guide, go flood compound.” Na so money be — if you no plan am, e fit cause wahala.Baba-God bless you no be just to make money, but to manage am wit sense, con make am grow. Make budget, avoid unnecessary show, save small-small, and invest where e go grow. Anoda proverb still tok sey, “Na who sabi keep key, go open door tomorrow.” Meaning sey pesin wey sabi save and plan fit open beta future. No dey carry pride run…

  • Blog

    Finish Strong, No Give Up

    Message: Today, Baba-God dey remind you sey wetin mata no be how you start, but how you finish. Life fit taya you. Pipo fit disappoint you. Situation fit make you wan stop. But no give up now. You don waka too far to turn back. Any pesin fit start well, but na pesin wey endure reach end na hin win crown. Learn to fisnh wetin you start and fisnih strong. Baba-God no dey forget your labour. Everi prayer, everi water wey komot from your eyes, everi good work wey nobody dey see—Baba-God dey see all of dem. And reward dey come. Wen strength dey low, put body on Baba-God. Wen…

  • Blog

    Give Tanks For Everi Circumstances

    Message: Today, Baba-God wan remind you sey gratitude dey pawaful. Even wen tins no dey perfect, even wen challenge dey, make you still fyne reason to thank Baba-God. Giving thanks dey shift your mind from sapa to abundance, from worry to peace. Wen temptation to complain or feel hard nack you, choose to dey give thanks. Wen plan no dey work like you plan am, still give thanks. Gratitude dey open door for more blessings. Baba-God dey notice pesin wey dey thankful. Thanking Baba-God no mean sey everytin don perfect. E mean sey you trust Baba-God even though situation no straight. Even small tin wey dey your hand, thank Baba-God…

Social Media Auto Publish Powered By : XYZScripts.com