Blog

No Fear, Baba-God Dey With You

:

Message:
Today, make you remember sey you no dey waka alone for dis life. Even wen tins hard, money tight, or pipo turn back against you, Baba-God still dey your side. Fear fit come knock your mind, but no allow am settle. Na trust in Baba-God be di key. Wen you carry your worries to Baba-God, He go give you peace wey pass human understanding.


Sometimes e go look sey notin dey work, but Baba-God dey work behind di scene. No give up. No lose hope. Keep praying, keep believing, and keep doing good. Baba-God timing no be your timing, but e always dey perfect. As you wake up today, tell yoursef sey: “I go trust Baba-God, no mata wetin I see.”
No forget sey Baba-God fit use small tins do big miracle. Dat small step of faith wey you wan bone fit be di door to your breakthrough. Even if pipo no notice your effort, Baba-God dey see am clearly. kontinu to do di right tin, even wen nobody clap for you. One day, your testimony go loud pass your struggle, and pipo go know sey na Baba-God carry you reach there.

Bible Verses:
“No fear, becos I dey wit you; no allow wahala shake you, becos na me be your God.”
— Isaiah 41:10 (Pidgin Bible)
“Carry all your worries give Baba-God, becos He care about you.”
— 1 Peter 5:7 (Pidgin Bible)

Prayer:
Baba-God my Fada, I put my life for Your hand today. Take away fear con give me strong faith. Make I trust You no mata wetin happun. Amen.

Positive Confession:
Today, I dey bold, I dey strong, and fear no hold me. Baba-God dey my side, and I go overcome everi challenge. Amen.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *